@nacos_pti info@nacospti.com.ng
Register | E-Portal
Back to Blog
News

SHIBIRI DON DO AM AGAIN

By Admin NACOSS · 05 Sep 2026
SHIBIRI DON DO AM AGAIN

Shibiri fixed the school light in the hostel...

If you dey PTI, you go know say Shibiri no dey carry last. One of our NACOS members, popularly known as Shibiri, don take it upon himself to help fix light and bulbs around some of the hostels in PTI. From the Girls Hostel to some of the Male Hostels, Shibiri don dey move around, fixing faulty bulbs and sorting out some of the light issues wey students dey face. Sometimes we dey complain when things no dey work, but e good to also appreciate people wey dey put effort to make things better. This one na something wey deserve small recognition. Shibiri, you try. No be every time person go wait for management before e fit do something to help. But make we hear from una... Which hostel or block don benefit from Shibiri's work? If you don see am around your hostel fixing light or bulb, tell us for the comment section. Make we know say Shibiri really dey work. PTI students, una own experience with Shibiri na wetin?

Comments and Experiences

ighorhonorhona Aruoture Emmanuel05 Sep 2026

i swear this guy they run things for us for the school. this kind of person we need in the society so humble

Admin reply

current guy

Opeyemi07 Sep 2026

Biggest of all time I dey see ur work Nice one

>